Choose a track to play
In this life, many things go make u wan dey falter
But if u stand strong and stay steadfast my guy u go go far
Many People go wan dey hinder your progress make you suffer
But no gree for them, wen they come meet u tell them waka
Cause baba God getti big plans for o, sey u go make am
Sey u go be head and not the tail oo, anywhere u enter
Cause His plans for u are of good and not of evil
Knock the door e go surely open oo
And Your story go be that you came and saw and he conquered
So Stay grinding, my brother stay grinding
Through the rain and the sunshine, my brother stay grinding
Through the ups and downs of life oo Baba God go dey by your side oo
And I swear you go chop this life oo but the only way you fit run am is if you stay grinding
Stay grinding, stay grinding, stay grinding xfour
More power more power to you o my brother in this life
Cause anything wey u wan getti oo, e go come with pain and strife
Be prepared to face the devil oo
He dey come against your destiny
Cause if he comes and you are not ready oo
He go work alongside your enemies
To distract you..retract you.. from the bounty God has given
Depress you.. repress you from your reward which is in heaven
Plant good seed in this life,what you sow you will reap my brother
There are many paths in the cobweb, but they all lead back to the centre
The Lord will prepare a table for you in the presence of your enemies
And when they finally see you rising, all they go fit doo
Wonder wonder