Elige una pista para reproducir
Chale gat hustle no money buy laptop
Steady Lagbaen (bricklayer)
Chale gat hustle to buy laptop
If life na competition
Chale for nor dey the game
Eyes on the bag Chale eye
Red pass benin moat
He need money that what he need most
Chale is depress too he friends dey ball For GH he wa still press too
Chale gat to hustle no girl wa date m
Any girl he talk to them go intimidate m
Na so so boy boy dem dey call m
Because he never reach man
So he gat to hustle
So he go be rich man
He know say the hustle nor be moi moi
If he gat the beans to cook m
Chale turn contractor
Steady everyday them dey book m
Chale gather money buy lapi
No smile for he face he no happy
December 2018
Chale move in the midnight
He reach lag 40k and one trouser
Na dey he bag
The next day chale reach Gh
Chale gat connection to ghana
He no want make he friends see this
Because when he reach there
Before two months three months later
Him go get the dollar and cedis
Get the dollar and cedis
Chale come,
Make I clear you my mind
This story no be fake my guy
Ishiala, I swear walahi, ye eeh
Orí mi gbono gbono gbono oh oh, Ori mi gbono
They talking shit, but them dunno
But Dem Dunno, orí mi gbono
Chale enter HK
Chairman ask m
Are ready or not
He said I'm not fugee or meek mill
But I'm ready
Chale hustle he nor dey rest
He want the money that is the best
Chale eye open 24 7 he nor dey sleep
He want the money that is the slip
He dey bomb pass
Boko haram wey dey north
Over thinking don dey make head go north
Chale catch client he never bill client
Chaile don dey reason percentage
Chaile is very sensitive
Chale friends for gh
None of them be bedsheets
But them dey spread for chale
Chale nor send,Chale nor mind
Anyone he talk to them go loseguard him
He nor care
Even Adam and Eve don lose garden
Chale focus
Chale no hustle for you or me
He hustle for family
Chale steady he dey pray
He turn HK to church
Chale He say Dear God
You know watin you promise oh
I no let me come be like say na moses
No come reach the promise o
Chale wa ball the ball
Wey he friends dey ball
Make no come be say
He reach he time to ball
Ref come blow whistle
Chale talk to God
You remember?
When i dey go church
Dey win souls
Run m for me
I know you dey all about protection
Like condom
You know say my mama born me smart
I nor come dumb
If you no bless me for this life
I go ask you
Watin you give me the life for
You know
Me i go ask watin you give me life for jor
Dear God
Chale come,
Make I clear you my mind
This story no be fake my guy
Ishiala, I swear walahi, ye eeh
Orí mi gbono gbono gbono oh oh, Ori mi gbono
They talking shit, but them dunno,
But Dem Dunno, orí mi gbono
Chale stay for one year
He no gree collect
Something enter he mind
Make i comot from here
Chale call House
Them send money enter 9ja
Chale Never give up
He reach hux he hustle
Mindset never change easily
Not switch
Things was very hard for him
All he want things will be better for him
Hood were laughing at him
He said I m not ashamed
I no shit for my body
I will make things right
I don't send anybody
Life is turn by turn
I'm gonna make things right
Chale come,
Make I clear you my mind
This story no be fake my guy
Ishiala, I swear walahi, ye eeh
Orí mi gbono gbono gbono oh oh, Ori mi gbono
They talking shit, but them dunno,
But Dem Dunno, orí mi gbono
Like delta pipe chale don burst
Two months later chale burst every where
Na him even dey call me sf
Chale afa na how e dey be
You don burst everywhere o
Dboykhalifah it not easy bro
Oya turn up for Quilox
Make we light up
You know the matter
One time