Elige una pista para reproducir
Yeah
Kolex again
Father lord
Hear me now as I dey cry
Run am for your boy
I know say I nor dey try
Nor be lie
I don tey inside the hustle
And the grind
So look me for my eye tell me
When I go smile
I know say I dey sin
But nor dey reason am
Na steady I dey call
But you dey busy am
I get songs die
No money to promote am
Mama dey jeddo
Jeddo don dey tire her
So shower your blessings
On this humble sinner
Wey dey hardly go to church
But still a believer
Oluwa I dey with you
Cos I know say you dey deliver
And for your daily blessings
Baba I dey receive am
Nor be lie
I don tire for effort without result
As I dey follow you dey talk
Baba my head dey hot
Wetin dey sup
All these stuffer got to stop
Heavenly Father your son
Nor suppose to dey dull
Father lord as I dey work
And I dey pray every night
Everyday bamishey
Bamishey bamishey o
Father lord as I dey work
And I dey pray every night
Everyday bamishey
Bamishey bamishey o
Father lord
I dey your premises
Cos of your promises
Your son nor strong
I really need your medicine
Nie be your grace and
Nie be your mercy
I want to live my life
With happiness
And no stressing
Father lord
Me I nor dey complain
Cos na your grace
Nie I take dey sustain
And when food nor dey my countain
I can still look all around
And see my blessings
And be counting
Just ask na wetin you talk
I don dey ask since o
Wetin cor dey sup o
I'm never tired
Me I nor dey dull o
Na six to six on the grind
Until the money come
I say me I know say
Na by grace nor be muscle
Me I know say
I need your grace for my hustle
Lord you know say
I nor want any trouble
Lord you know say
I don hustle so tey
The hustle nor gree pay
Father lord as I dey work
And I dey pray every night
Everyday bamishey
Bamishey bamishey o
Father lord as I dey work
And I dey pray every night
Everyday bamishey
Bamishey bamishey o