Elige una pista para reproducir
See i'm lyrically psycho
Aje i fit murder any beat
If you reason say i wack oya do am if you fit
No be by mouth see na action wey de speak
Me i no de rap when i spit 16
You go think say i de preach
But the nigga no be priest
Call me dead shot
Why?
Cuz i no de miss
Omo this mic
Fit de think say i be dragon
Cuz na fire wey de comot anytime wey i de spit
Do am for my guys & my niggas in the street
Me i no be vegan always ready for the beef
If i sabi sing i for de do am like wizzy
Or wande
Weytin you de find e go sup gee na one day
I gaz hot o the world too cold
Like banger for December G
When the time come me i go still blow
Na why i no de rush i de take things slow
Na just small time wey remain we go blow
(ehhh ehhh)
The working we de put e go show
The niggas wey de doubt small time they know
(ehhh ehhh)
Like naira issa goal goal
Keep it in
That's a line for the wise
Cuz nobody fit get you
No go too de beg
Who go help you no go stress you
Baba I de hustle 9-5
Every night I de grind
Make I guide
To fit body instrumental
I de overthink e been small wey I go mental
Omo when e click see it's not coincidental
No be overnight success
E don tay wey i de grind
Early momo I de pray say the music wey I drop
Make e pop make the money long
When I climb stage if I rap make sing along
I wan drive Benz bro make I fly along
You tell me say I got you
Why you no de show me love
I no de online all day guy
Nobody been call
Just to ask me how I'm holding up
Many things I no go talk but
Oluwa my story gaz change
I wan buy Benz wey get zero mileage