Ahh-yeahh…
Christmas vibe
Everybody make we dance
Jesu Ovie Emmanuel
Oya move move move
Joseph, a just man, calm and gentle
See the matter, e dey heavy for him mental
He no wan disgrace Mary for the temple
He say, make I free am small, make e no cause trouble
But as Joseph dey think am for the night oh
Angel show for dream with heavenly light oh
"Joseph, son of David, no dey fear, no fight oh
Take Mary as your wife, everything go right oh
Wetin she carry, na the Holy Ghost do am
A Son go come, and you go name am Jesus
Because na Him go save the world from sin
Redemption don land, make the whole world sing
Joy to the world, the Lord is come
Make every heart prepare Him room (oh yeah)
Make every heart prepare Him room (oh yeah)
We dance and sing, Emmanuel
God dey with us, tell everybody well
Joy, joy, joy… joy to the world
All these things happen make prophecy complete
Word wey dem talk don manifest for the street
Virgin go carry pikin, the prophet don speak
And she go born Emmanuel, God wey dey with us
Joseph wake up, obey the angel sharp
Take Mary as him wife, no delay, no drag
He no touch her till the Son arrive
Firstborn, Jesus, Light of Life
Omo, the King don show
Messiah don come, make the whole world know
Celebrate Christmas with praise and flow
Lift your voice, make your blessings grow
Joy to the world, the Lord is come
Make every heart prepare Him room (oh yeah)
We dance and sing, Emmanuel
God dey with us, tell everybody well
Joy, joy, joy… joy to the world
Joy, joy, joy…God dey with us
Tell everybody well... joy to the world
Tell everybody well... joy to the world...
Emmanuel, God dey with us
Jesu Kristi, Saviour of the world
Celebrate, make we elevate
Christmas time,na to jubilate
Move your body, no delay
Jesus don come, make we celebrate
Emmanuel, na Him be the way
Merry Christmas, everybody with love
From PrisLex Dynasty…