Оберіть трек для відтворення

Сингл / Трек
Chairman o
I no dey loyal today
Chairman how you go like
To dey on the side of justice
Eli aiwa weru iway
We don tire to dey chop shit
Chairman o
I no dey loyal today
E get this matter wey dey worry me
Na about this our brother wey them dey call Ebube
I dey pass for road, people dey beatam
I say e ya... I knowam, make una leavam
Them say him go thief pot of soup
I say chai... I give them money
I carryam go house
I reach him house, him mama dey for bed
She dey sick, she don almost rotten
I say how una dey treatam
Him say them no get money for hospital
Hey
Im sister sef dey sick, him dey alone
Him no get job
Mr. Chairman
Wetin we go do to help these people
Build them hospital, give them job
Ebube sef na electrician
Chairman how you go like
To dey on the side of justice
Eli aiwa weru iway
We don tire to dey chop shit
Ok
E no finish there
Now, we bring the woman and her daughter
Away from the house
We call neighbours, make them help
Na im neighbours come
Some neighbours talk say them too
Get sick people for their house
Say them never chop
I say ahaa
We come hire more motor
Na wetin carry us come here
Chairman
You be our local government chairman
All the money wey we dey get
How many e dey
Na where e dey
Na who holdam
We wantam back, na our own
We go build for ourselves
Abeg Mr. Chairman
We no want insult you
But make you no insult us
We hearsay you carry our money build your own house
We dey thief for road
Police dey arrest us
We no get money for bail
Mr. Chairman
Chairman how you go like
To dey on the side of justice
Eli aiwa weru iway
We don tire to dey chop shit
Yes o
Chairman, you go comot hand for the leadership
You go step down
We no need who go school
We need who like us, who get conscience
We go help ourselve
No put your hand again
Nhnn
We go treat ourselves
Thank you