Оберіть трек для відтворення
See flower plenty for grave
But na wetin you no go see when you dey alive
Dead body dey try for grave
Because wetin Hin no wan hear hin go hear
He no get choice
See enemy dey claim your friend
But for hin mind he Don kill you tey tey
Dead body dey try for grave
Because wetin hin no wan hear hin go hear
He no get choice
Omo Mogbe this one dey pain
Which one be say we be bestie when I dey
Ololade you get Owo
But you say you. No fit waste your money on my case (2x)
Interlude
If you dey for me tell me before I die o
Dead body no Sabi I love you
If you dey for me dey with me before I die o
If you wan love me
Come and love me now before I die o
No be when I die
Dead body no Sabi I love you
If you dey for me come and dey with me before I die o
No be when I die dead body no Sabi I love you
Dead body no Sabi I love you (2x)